Nigeria goment shut down Lead British international school Abuja over viral bullying videos

Lead British international school Abuja

Wia dis foto come from, Lead British international school Abuja/Facebook

Nigeria goment don shut down Lead British International School Abuja.

Di Minister of Women Uju Kennedy-Ohaneye order di closure of di school afta case of bullying dey reported for di school.

Plenty videos of how students of di “big-man” school take dey assault dia fellow students bin surface and go viral on social media on Monday.

Di video spark sharp reactions online as some video show how some angry parents enta di school to express dia grievance.

Di women affairs minister for statement say di school go dey closed for three days to enable authorities fit carry out investigation on di mata, also to enable di school authority fit put surveillance measure in place to monitor students wey go later commit acts of bullying or any oda yamayama behaviour.

“As I reach di school I see plenty parents wey come di school sake of dis same mata and dem tell me say bully na normal thing for di school as dem complain say dia children don pass through similar experiences.” Ms Kennedy-Ohaneye tok.

Meanwhile, di FCT Police Command say dem dey on top di situation.

Di police tok-tok pesin Josephine Adeh for one statement on Monday say dem don send well trained officers go di premises for investigation and to stop any possible breakdown of law and order.

Di management of Lead British International School for Abuja, Nigeria capital bin react to di trending video wey highlight di issue of bullying for di institution.

For inside one statement wey di school post on dia Facebook account, dem condemn di mata and add say dem don begin investigate di mata.

“Lead British International School, Abuja dey deeply concerned about di recent incident of bullying wey don come to light, and we wan assure di school community plus di public say, we dey take di mata very seriously.”

Di school management reaction come afta different videos wey go viral on social media, wey show case of bullying for di school.

One X user @mooyeeeeeee wey post di video tok say she dey find justice for one female student of di school wey her classmates bully.

Wetin dey di video

For inside di “Save Our Soul” message, @mooyeeeeeee post on Monday night wit two videos, she tok say she need di video to go viral so dat di victim go fit get justice.

Inside one of di videos, e show as one female student dey slap anoda student and dey ask say “Who broke my heart?”.

Anoda video show as two students dey slap di girl simultaneously and one male classmate wey siddon near her dey say “I spoil her relationship.”

Di victim no tok anytin as dem dey beat her, she just dey look as she dey receive slaps for her face.

Oda videos don surface wey show incident of bullying for Lead British International School, one show as some boys dey bully anoda student and odas.

Dis videos don provoke plenty reactions on social media.

Wetin di school tok

Since di video go viral, di school management for statement say dem don take some steps to address di mata.

  • Investigation: Di school say dem set up dedicated team to carry out thorough investigation into di mata. “Di team don begin gada information, and dem don dey review video footage and interview witnesses to understand di fill scope f di incident and identify di immediate remote causes”.
  • Providing support for victim and family: We go reach out to di victim and her family wit a view to providing support, including access to counselling services to help dem cope wit di emotional and psychological impact of di incident, di school tok.
  • Review and update Anti-Bullying Policies: Di school management also say dem go review and update di anti-bullying policies ti determine areas wey need improvement, wit focus on prevention and early detention. Dem add say LBIS go also implement educational programmes and workshops for students, staff and parents to raise awareness about bullying and its consequences.
  • LBIS also say make anyone wey get information about dis mata or oda incidents of bullying for di school to come forward and report to di school administration.
Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Maryam tok sorry to Namitira for di bullying

Di student wey dem say her name don tok sorry to di oda student she assault.

For one video wey dey make di rounds, Maryam tok say, “I sincerely dey sorry for wetin I do Namitira. I also apologise to everyone out there, I wish e neva happun.

Lead British International school wey dem establish for 2007, dey offer British curriculum blended wit di Nigerian education system.

E dey rated as one of di most expensive schools in Nigeria, according to local media.

Signs wey show say dem fit dey bully your child

Students in classroom

Wia dis foto come from, AFP

Psychologist Anjula Mutanda follow BBC tok on how to spot signs of bullying wey include:

  • Pikin fit dey vex or cry every time and you no fit place why.
  • Your pikin dey withdraw and fit tell you all di time say dem wan stay for house.
  • Or dem fit dey make excuse say dem no dey feel fine on school days. Even wen dem dey fine and full of energy for weekends.

"Wen e be like your pikin dey say or do anytin to avoid school, e dey important to check in wit dem," she tok.

She say di first step as a parent na to stay calm wen you notice pattern of withdrawal, or see say dem dey express anxiety.

Di next tin na to make sure say your pikin fit follow you tok about wetin dey happun to dem.

Wetin Parents/guardian fit do to protect dia pikin from bullies

Child Protection expert, Taiwo Akinlami follow BBC News Pidgin tok say e get many tins wey parents fit do to prevent dia pikin from bully or immediately dem get di report or see any sign say pesin don bully dia pikin for school.

Child protection system: Oga Taiwo say di first tin wey parents or guardian must do before dem even register dia pikin for any school na to ask if di school get written child protection system.

For inside dis policy, e go dey clear wetin schools dey do to protect every student. Also wetin dem go do if e get any reported or suspicious case of molestation.

Complain and demand action: If parents no gree see any child protection policy and dem don already register dia pikin for di school, di next line of action wen dia children complain of bully for school na to immediately take am up wit di school authority by complaining.

Di child protection expert wey also be lawyer tell BBC Pidgin say parents/guardian must demand for something to be done about am.

Pscycho social support: Afta reports of bullying, Oga Taiwo say parents must give dia pikin pscycho social support.

"You need counselling for your pikin, because bullying no dey leave pikin wia e meet am. You need to get your child, help."

Create working talking relationship wit your pikin: "Let your pikin know say you dey available to tok to and respond anytime," oga Taiwo tok. E say dis one go make di pikin dey confident to always tok.

Consider legal actions: E also say if any cases of bullying come up against your pikin and you don report am to school and dem no take any action, Taiwo say make parents/guardians consider taking legal action against all di pipo wey dey involved.

"Finally, e dey important for you to comot your child from di school, if dem no fit help you."

Oga Taiwo also say to prepare your child for di world today, e dey important for parents and guardians to build resilience in dia pikin, tell dem wetin to expect out dia and how to react.

Wetin schools management fit do to end bullying?

For interview wit BBC News Pidgin, Nnena Okore wey be principal for one school for Lagos, for southwest Nigeria say e dey important for schools to put up policies against bullying.

She say di first tin be say schools must get policies wey parents go sign without fear say dia pikin no go get hand for any act of bullying or dem go face punishment

She also tok about standard protection policy wey goment go monitor for all school. Wetin dis mean say schools must get proper medical care to cater to any health need of any child.

According to her, "counselling department for schools also dey important. Madam Nnena say dis go allow students speak freely to dia counsellor, complain about any form of bullying and for those wey also dey bully oda students, di counsellors fit also do reform sessions wit dem.