How Abuja FCDA tear gas resident demolish dia house for early morning

- Author, Dooshima Abu
- Role, BBC News Pidgin, Abuja
Imagine say you be house owner wit good business and one morning you wake up and everitin vanish. You come begin live from hand to mouth, for uncompleted building wit your five pikin dem.
Dis na di tori of Mama Yakubu wey loss everitin wey e don work for many years afta FCT goment demolish her house for Abuja.
Mama Yakubu don dey deal in pure water business for Apo Akpmajenya area of Abuja for years.
Na from dis business she dey feed her family plus pay di pikin dem school fees, but now she don loss everytin including her hope for beta future for her pikin dem.
" Dem destroy all my water cooling machine plus my house. Di demolition pain me well-well sake of say I now live for uncompleted building and I no fit get moni to rent anoda house", she explain.

Officials of di FCDA on Saturday bin cari plenti security officers dem wit heavy guns go Apo Akpmajenya. By 3 am dem don surround di community as if na Boko Haram dem dey fight with.
Some of di resident bin dey sleep but around 4:am, di security pipo begin tear gas di pipo as bulldozers dey destroy dia houses .
Di pepper plus smoke and rush-rush no allow some of dem pack dia load, but to run for dia lives.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mama Ruth now dey sleep inside car wit her husband as di place wey dem call dia home, no dey again.
She bin dey run five stores before but now she dey sell for ground to fit survive.
"Homeless and hopeless"


Di emotion for di face of di pipo na dat of anger, sadness and disappointment. Many of dem still dey stranded wit no hope on how to move dia life forward.
Some of dem still dey search through di remains of di houses wey dem bin call dia own.
Apo Akpmajenya belong to gbagyi pipo but na business pipo from different part of di kontri dey live and hustle for di area.
High cost of rent for Abuja dey make middle income pipo to live for dis area.
FCDA Justify why dem Demolish di house

Federal Capital Development Authority (FCDA) say dem bin don sama warning say make dem pack out of di area sake of say dem gatz construct one major road.
Deputy director, planning and resettlement for di department of resettlement and compensation, Malam Nasir Sauleiman bin say goment don build 131 houses plus 169 plots for di indigenes.
E add say dey don engage dem to prepare dem to leave di area.
Upon say goment and gbagyi pipo dey tok, di indigenous pipo kontinu to assure business pipo and dia tenant say nothing go happun.
Sake of dis false hope, di pipo come relax dia mind.
Abubakar Yahaya wey get huge store for di area, say if to say di gbagyi pipo tell dem, dem for prepare to pack. Now e loss everitin and dey try sell one or two tins for table to take hold bodi togeda.

Danlami na tailor, e loss all im sewing machine and livelihood. E no comot pin from im house and na di only cloth wey dey im body remain.
E explain say di hour wey di security begin tear gas dem, make am dey hard to pack im kaya.
" as di bulldozer dey demolish my house, I begin cry sake of everytin wey I loss"
Danlami now dey jobless and no wia to lay im head.
Reaction by gbagyi Leaders
Di tok tok pesin for Original Inhabitant Development Association, David Aboki say di goment no build houses for di pipo
But dat dem give dem land for bush and e no dey secure for di pipo to live dia.
E say dem go gada dia facts and drag goment to pay for dia action.
While di indigene get opportunity to get compensation, Mama Yakubu and her fellow neighbour go kontinu to count dia loss.












