Eid-al Fitr: Tinubu and oda world leaders call for peace

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President, Bola Tinubu dey celebrate di 2026 Eid-al-Fitr wit oda Muslims around di world.
Di Nigerian president wey just return from di United Kingdom wia e bin go on a two-day working visit tell Nigerians for im Eid message, to reflect on di learning and teachings wey dem get during di Ramadan fast.
For statement wey di presidency release, wey tok-tok pesin Bayo Onanuga sign, President Bola Tinubu call for "renewed patriotism".
E congratulate all Muslims for Nigeria as e tell dem to commit to di nation and humanity.
"We get plenti tins to take from di noble lessons of Ramadan, especially for dis time. We must continue to abide by di virtues of piety, selflessness, perseverance, kindness and compassion beyond dis period," im tok.
Oga presido ginger Muslim leaders to use dis occasion to offer prayers for peace and prosperity for di kontri.
President Bola Tinubu land Lagos, Nigeria early mor-mor on Friday to celebrate Eid.
As part of im Eid-al-Fitr programme in Lagos, di president go pray for di Eid prayer ground of Dodan Barracks, on Friday morning.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin oda World leaders tok
US President, Donald Trump send Eid message to "evri American wey dey celebrate Eid al-Fitr.
For di message wey US website post, Donald Trump tok say "Eid al-Fitr, also known as di Festival of Breaking di Fast, unite Muslim families, friends, and communities in honor of dia spiritual devotion wey conclude Ramadan.
'E also serve as a reminder of di foundational American principle of religious liberty, which my Administration dey fight for evriday.
President of di United Arab Emirates, (UAE) His Highness Sheikh Mohamed bin Zayed Al Nahyan, for im Eid message tok say:
"We dey confident say our region go overcome di current challenges, and say di UAE, through dia strength, resilience, and di loyalty and unity of di pipo, go continue to advance towards a peaceful and prosperous future."
Dis message dey come as ogbonge kasala dey hapun for di middle east and some missiles also land for di UAE recently.














