Senegal go return 2025 Afcon trophy to Morocco?

Senegal football captain, Sadio Mane raise di 2025 Afcon trophy as im team lift am up with di trophy.

Wia dis foto come from, FRANCK FIFE / AFP via Getty Images

Read am in 5 mins

Since di Confederation of African Football [Caf ] hand over di 2025 Afcon trophy and win to Morocco on Tuesday, questions if Senegal go really return di trophy and medals and how Morocco take win full ground.

Caf announce di decision of di Disciplinary Board for inside statement wey dem release on Tuesday wia dem also reverse some of di decisions wey dem make.

Dis dey come afta Morocco bin complain to Caf about di kasala wey bin hapun for di 2025 Afcon final on 18 January, 2026.

Dis na answer to some of di top questions wey una dey ask

How Morocco take win 2025 Afcon afta two months wen dem lose?

Morocco wey be di hosts of di 2025 Africa Cup of Nations become winners of di Afcon sake of decisions wey hapun for Caf boardroom.

Caf crown di North Africans champions afta di Disciplinary Board find Senegal guilty sake of say dem break Article 82.

According to Caf, Article 82 tok say, "If for any reason whatsoever, a team withdraw or no showup for di match or refuse to play or leave di ground before di regular end of di match without di authorisation of di referee, dem go consider am loser and dem go remove di team from di competition for di good of di competition. Di same go apply for di teams wey Caf bin don disqualify bifor."

Article 83 tok say : A team wey no dey present on di ground, dressed to play at di time wey dem fix for kickoff or at most 15 minutes later, go forfeit di match. Di referee go register di absence of di team and e go write am for im report, di organising committee go take di final decision for dis aspect.

Article 84 tok say "di team wey go break Article 82 and 83 go comot from di competition for di good of di game. Di team go lose di match by 3-0 unless di team don score a more advantageous result at di time wen di match dey interrupted, in dis case dem go maintain di score, di organising committee fit adopt oda measures."

Na on dis grounds wey Caf award three goals to Morocco sake of say Senegal comot from di pitch wey contravene article 82.

From dis Caf decision, e mean say Morocco beat Senegal for di final by 3-0 sake of say Senegal waka comot from field.

Senegal go return di trophy and medals?

Di reality of di mata be say Senegal no go return dia trophy and medals to Caf or to Morocco yet, until di Court of Arbitration for Sports chook eye inside di mata and give judgement.

On record, na Senegal still be di winners of di 2025 Afcon legally and nobody go address Morocco as champions until CAS finish di case and rule ontop am.

Court of Arbitration for Sports be like di Supreme court and na wetin dem tok be final.

Senegal go still be champions of di 2025 Afcon until di mata finish for di sports court.

How Senegal and Morocco react

Senegal say dem no go agree wit di disciplinary decision wey Caf take and dem go follow di mata to di end.

For statement wey di Senegalese Football Federation (FSF) release, on 17 March, 2026, dem tok say dem don "take note of di notification of di decision by di Appeals Board of Caf for case DC23316.

"Di Senegalese Federation reject di unfair, unprecedented, and unacceptable decision wey discredit African football."

Di football federation say dem go defend dia rights to any level.

"Di federation go initiate an appeal as soon as possible before di Court of Arbitration for Sport (CAS) for Lausanne.

"Di FSF reaffirm our unwavering commitment to di values of integrity and sporting justice."

Meanwhile Morocco say, "di approach no dey intended to challenge di sporting performance of di teams wey participate for dis competition, but na only to request make dem apply regulations for di competition".

For statement, dem tok say dem dey committed to respect di rules and ensure clarity for di competitive framework and maintain stability within Africa.

Dis tin don hapun bifor?

Sometin wey resemble dis case don hapun bifor but no be exactly like dis.

For 2019, dem bin abandon di Caf Champions League final match sake of kasala wey hapun becos of di Video Assisted Referee (VAR) system.

Di match stop for over one hour afta Wydad Casablanca no gree play again sake of say VAR bin no dey to judge di equalising goal wey Wydad score but referee cancel am.

Dem bin setup di VAR for di side of di pitch, but dem bin no tell di players say e no dey work but di officials sef bin know say e no dey work.

Di referee later award di victory to di three-time former champions Esperance.

Di Tunisian side bin dey lead 1-0 (2-1 on aggregate) wey dem bin play over two legs. Dem bin use VAR for di first leg. For di second leg, dem cancel goal sake of infringement.

Wydad players bin protest to di Gambian referee, as dem bin demand say make dem use VAR check am, di Confederation of African Football (Caf) president dat time, Ahmad Ahmad bin spend almost 30 minutes in discussions wit officials so dat dem fit restart di match.

Anoda case na wen for January 2010, Caf sama West African team, Togo two years ban sake of say dem bin pullout of di Africa Cup of Nation.

Di govment of Togo withdraw from di tournament afta jaguda pipo attack dia coach.

Caf president dat time, Issa Hayatou, bin tell tori pipo say dem sama reason Togo ban sake of "govment interference".

Three pipo bin die for di Togo squad as gunmen bin ambush di team wen dem bin dey travel thru di Cabinda region of Angola.

Togo players go back to dia house afta dem ask Caf to give dem time to mourn dia teammates wey die for di attack. Caf officially disqualify dem from di tournament afta dem no show up for dia opening game against Ghana.