King greet Nigerian president for di first UK state visit in 37 years

King Charles III wit di President of Nigeria Bola Ahmed Tinubu on di Royal Dais during a welcome ceremony for Datchet Road for Windsor. Both men wear black, wit King Charles wey wear three-piece suit

Wia dis foto come from, PA Media

    • Author, Sean Coughlan
    • Role, Royal correspondent
  • Read am in 6 mins

King Charles dey host di first Nigerian state visit for di first time in 37 years, wia e give President Bola Ahmed Tinubu and im wife Oluremi Tinubu ceremonial welcome for Windsor Castle.

For di state of di two days waka, di leaders from di African kontri wit di most population wey be times three of UK, get greeting from senior royals wey include Queen Camilla and di Prince and Princess of Wales.

Di King and President Tinubu go give speeches on Wednesday evening for di state banquet wey political leaders and celebs wey get link to Nigeria go attend.

But dem no go do di traditional lunch wit di King for Windsor sake of say di president na Muslim wey dey fast for Ramadan.

DiPrince and Princess of Wales receive President of Nigeria Bola Ahmed Tinubu

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Di Prince and Princess of Wales meet President Tinubu

Di president and first lady land for di UK on Tuesday. Dem give dem di ceremonial grandeur of di royal welcome. E bin include carriage procession and den military parade for di manicured lawns wey dey inside di Windsor Castle.

Na Prince William and Catherine, Princess of Wales bin welcome dem for di ogbonge spa hotel wey dem dey call Fairmont Windsor Park bifor dem come escort dem enta town to formally meet di King and Queen.

As di carriage procession wey carry di King and president enta Windsor Castle quadrangle, dem jam guard of honour and di band of di Grenadier Guards wey bin play di Nigerian and british national anthems as dem travel round di square.

For di spring suchine, Tinubu do di ceremony of inspecting di troops wey bin dey on display as King Charles dey follow am from behind.

Queen Camilla follow Nigeria First Lady Oluremi Tinubu ride inside carriage

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Queen Camilla follow Nigeria First Lady Oluremi Tinubu ride inside carriage
A Sovereign Escort of di Household Cavalry, gather ahead of di arrival of King Charles III and Queen Camilla to receive President of Nigeria Bola Ahmed Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu at Datchet Road in Windsor

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Di Nigerian president bin enta Windsor to pomp and ceremony

State visits na way to build relationships wit international partners and di Nigeria visit fit strengthen business links wey include financial services.

E pass 270,000 Nigerian born pipo live for di UK.

Nigeria goment tok-tok pesin, Mohammed Idris, "dis state visit na about turning fi historic relationship into mordern economic partnership - transforming trust to opportunity".

E add say, "Nigeria economic reforms dey unlock di potential of Africa lrgest consumer market. Di United Kingdom na natural partner for wetin go come next. Dis visit dey mark di next step to deepen co-operation across trade, finance and defence".

Later, exchange of gifts and displays of items go happun wey dey related to Nigeria wey dey for di Royal collection, bifor dem go chop rich state banquet for St George Hall.

President Tinubu and im Christian wife go go lay wreath of flowers for di tomb of di late Queen Elizabeth II for St George Chapel.

Di couple go also go interfaith event wey dey designed to buld bridges between religions.

On Thursday, Madam Tinubu wey also be ordained pastor go preach for one service for di Lambeth Palace and go link up wit representatives from di Church of England.

Di Tinubus na Youba from di south-west dem be. E be one of di kontri biggest ethnic group wey get both Muslims and Christians inside.

Infact, Nigeria 220 million pipo dey mostly split half-half across religions as na mostly Muslims dey di north and na mostly Chirstians dey di south.

Presidnet Tinubu dey face growing international pressure to deal wit insecurity and do more to protect weak pipo. Mostly from di US President Donald Trump administration wey dey raise concern as to how dem dey treat Christians for Nigeria.

Dis na even though Nigeria govment don say na members of all faiths dey collect wetin dey do di kontri and dia security palava.

Dis include Islamist insurgency, kidnapping for ransom by criminal gangs, clashes ova land and seperatist unrest wey dey nromally tounch ehtnic and religious indentities.

For Borno state dis week, at least 23 pipo die and 108 wound for series of suspected sucide bombings wey don dey blamed on Boko Haram.

President Tinubu condemn who im call "evil minded" terror groups - and MPs for di UK don call on protection of freedom of worship for Nigeria.

Di visit dey hold as di war for di Middle East and kasala for Ukraine still dey go on. Even as Ukraine President Zelensky meet King Charles on Tuesday.

Di banquet go also be di King first speech since dem arrest im broda, Andrew Mountbatten-Windsor.

Wetin Tiinubu state visit mean for Nigeria-UK ties

King Charles bin host reception for St James Palace on Thursday to celebrate di Nigerian diaspora

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, King Charles bin host reception for St James Palace on Thursday to celebrate di Nigerian diaspora

President Tinubu don meet King Charles bifor as dem jam each oda last September and for COP28 for Dubai but dis visit get more diplomatic significance.

Sunday Dare, wey be advisor to President Tinubu tell di BBC say Nigeria fit gain through, "increased investment, technology transfer, job creation and deeper financial cooperation wey fit support economic growth."

As di relationship between di governance of Nigeria and UK dey now, di UK MPs don raise concerns wit di Foreign Secretariat about di attacks on Christians for Nigeria. Earlier dis year, di UK Special Envoy on Freedom of Religion or Belief bin hold adjournment debate for parliament on top dis mata.

According to BBC tori pesin, Makuochi Okafor, dis waka for President Tinubu go need careful balancing act to hype di beta tins wey dey happun for di kontri, strengthen UK-Nigeria ties and to ansa concerns wey international partners dey bring come outside.

Dis visit dey come months afta di UK govment comot wit dia "new approach to Africa" for December 2025 wey wan ginger partnerships wit African kontris for "mutual long-term benefits".

For di United Kingdom, dis visit fit strengthen trade ties, expand investment opportunities and ginger strategic engagement wit Africa biggest democracy and one of im biggest markets,

Govmnet numbers show say trade between di two kontris pass £8bn from last year. Dis make Nigeria one of UK most important partners for Africa.

In fact, bifor President Tinubu state visit, King Charles bin host reception for St James Palace on Thursday to celebrate di Nigerian diaspora and dem don add to areas like arts, culture, technology and finance.

Di King don famz Nigeria bifor, wen e still be Prince of Wales, e bin visit di kontri four times. E don also tok say e like Nigerian music and don follow flow small for Nigerian Pidgin.