Nigeria, Burkina Faso, odas top list of global terrorism ranking

A car is on fire after a suicide bombing which was staged by a suspected female suicide bomber near a campaign rally at Pantami Stadium attended by President Goodluck Jonathan and also killed at least five people and injured 8 others in Gombe, Nigeria on February 02, 2015.

Wia dis foto come from, Stringer/Anadolu Agency/Getty Images

Read am in 5 mins

Nigeria, Burkina Faso, Mali, Niger and Israel dey among di top ten for di new global terrorism index ranking 2026.

Di Global Terrorism Index (GTI) na study wey dey analyse di impact of terrorism for 163 kontris wey cova 99.7 per cent of di world population.

According to di 2026 global terrorism ranking, six of di top ten kontris wey dey impacted by terrorism dey for sub-Saharan Africa.

Dis make Africa as di epicentre for terrorism for di world.

Meanwhile, for di first time, Pakistan lead di ranking as di kontri wey dey most impacted by terrorism, as dem get 1,139 deaths and 1,045 incidents for 2025. dat na dia highest level since 2013.

Nigeria sidon for di fourth position of di global terrorism index wit 171 incidents, 750 fatalities, 243 injuries, and 67 hostages.

Burkina Faso dey second position, Niger dey third while Mali dey fifth position for di terrorism ranking as Israel sidon for tenth position.

Di report find say Islamic State (IS) and dia affiliates remain as di deadliest terrorist organisation for 2026 as dem dey responsible for about 17 per cent of all attacks worldwide.

According to di 2025 report, Nigeria record 565 terrorism deaths for 2024, wey be di highest afta Iraq.

For dat year, deaths for Nigeria bin reach 2,101 for 2014, bifor e drop to 392 in 2022, di lowest level since 2011.

Highlight from di 2026 Global Terrorism Index ranking

  • Di Sahel region remain terrorism epicentre, accounting for ova half of all global terrorism deaths.
  • Sahel dominate di 10 kontris most impacted by terrorism.
  • Di deaths from terrorism reduce by 28 per cent to 5,582, and incidents decrease by 22 per cent to 2,944, to make am di lowest figures since 2007.
  • Western terrorism fatalities rise sharply by 280 per cent to 57 for 2025, largely sake of antisemitism, Islamophobia and political terrorism.
  • Iran risk becoming anoda breeding ground for terrorist militias if dem become failed State.
  • Escalation of di conflict for Iran fit further scata di Mena region and increase di risk of groups wey dey behind Iran to carry out terrorist attacks overseas.
  • Islamic State (IS) expand dia operations to 22 kontris and remain di deadliest terrorist organisation for 2025 ranking, causing 1,805 deaths, wit 71% of dia activity for Syria and DRC.
  • Tehrik-e-Taliban (TTP) emerge as fastest-growing terrorist group, wit 90 per cent increase in deaths wey dey attributed to dem.
  • Deaths for sub-Saharan Africa (excluding di Sahel) now dey for di lowest since 2016.
  • Terrorist attacks jump by 63 per cent for di West, and Europe dey most affected wia attacks double to 67.
  • Seven Western kontris dey di first 50 most impacted kontris for di Global Terrorism Index.
  • Antisemitic and Islamophobic hate increase globally, wit di US seeing 200 per cent rise in antisemitic incidents for 2024.
  • Burkina Faso suffer di worst impact from terrorism, wit deaths increasing by 68 per cent despite attacks decreasing by 17 per cent.
  • Iraq record di largest improvement wit deaths from terrorism falling by 99 per cent since di 2007 peak.
  • Deaths from attacks by unknown Jihadists globally dey eight times higher dan 2017, representing 32% of all terrorism deaths and 18 times higher for di Sahel.
  • Drone technology and dia use continue to rapidly increase, especially wit groups such as IS, Boko Haram and Houthis.
  • Terrorism don become more concentrated, wit 119 kontris recording no deaths, di best result since 2007.
  • Terrorists dey use more advanced technologies including drones, GPS systems and encrypted messaging services.

African kontris wey no dey impacted by terrorism for 2025

For di 2026 ranking, some African kontris no get any case of terrorism activities.

Dem include:

  • Botswana
  • Republic of Congo
  • Gabon
  • Ghana
  • Guinea
  • The Gambia
  • Guinea-Bissau
  • Equatorial Guinea
  • Liberia
  • Lesotho
  • Morocco
  • Namibia
  • Madagascar
  • Mauritius
  • Rwanda,
  • Sierra Leone
  • South Africa
  • Zambia
  • Zimbabwe

20 Global Terrorism Index ranking

  • Pakistan
  • Burkina Faso
  • Niger
  • Nigeria
  • Mali
  • Syria
  • Somalia
  • Democratic Republic of the Congo
  • Colombia
  • Israel
  • Afghanistan
  • Cameroon
  • India
  • Myanmar
  • Mozambique
  • Iraq
  • Russia
  • Iran
  • Benin
  • Thailand
  • Kenya
  • Palestine
  • Philippines
  • Indonesia
  • Yemen
  • Chad
  • Chile
  • United States of America
  • Germany
  • Togo
  • Australia
  • Egypt
  • Burundi
  • Uganda
  • France
  • Türkiye
  • Ecuador
  • United Kingdom
  • Ukraine
  • Greece
  • Tajikistan
  • Bangladesh
  • Oman
  • Jordan
  • Czechia
  • Sweden
  • Algeria
  • Poland
  • Peru
  • Tunisia
  • Austria
  • Netherlands
  • Canada
  • China
  • Belgium
  • Angola
  • Malaysia
  • Senegal
  • Libya
  • Italy
  • Djibouti
  • Brazil
  • Tanzania
  • Spain
  • Bosnia and Herzegovina
  • Serbia
  • United Arab Emirates
  • Switzerland
  • Norway
  • Denmark
  • Cote d' Ivoire
  • Lebanon
  • Slovakia
  • Finland
  • Japan
  • Central African Republic
  • Georgia
  • Kosovo
  • Argentina
  • Saudi Arabia
  • Armenia
  • Ireland
  • Lithuania
  • Portugal
  • Venezuela
  • South Korea
  • Mexico
  • Ethiopia
  • Nepal
  • Cambodia
  • Latvia
  • Cyprus
  • Azerbaijan
  • Belarus
  • New Zealand
  • Uzbekistan
  • Iceland
  • Eswatini
  • Bahrain
  • Albania