Nigeria and DR Congo enta gbege as Fifa sanction dem ova 2026 World Cup qualifying playoff final

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/DeFodi Images via Getty Images, Ulrik Pedersen/DeFodi Images via Getty Images
Football govning body, Fifa don sama Nigeria and DR Congo wit fine sake of dia 2026 Fifa World Cup qualifying playoff final.
Dis new sanction dey come for time wey Nigerian football fans dey wait to see if dia protest to football joinbodi Fifa, against DR Congo wey beat dem for di African playoff final go dey successful.
For November 2025, DR Congo beat Nigeria on penalties for dia bid to reach di 2026 Fifa World Cup.
Afta di Super Eagles lose dat play-off match, dem submit complaint say DR Congo bin use ineligible players - players wey no qualify.
Fifa bin release list of disciplinary measures wey dem take against some cases but dem say some 'decisions dey subject to appeal.'
Wetin be Nigeria and DR Congo offences
Fifa fine Nigeria Football Federation (NFF) sake of throwing of objects during di match for November 2025.
While for Congo Football Association, dem sama dem sake of say dem use laser pointers during di match.
- Order and security at matches, throwing of objects - fine 1000 (1300 USD)
- Use of laser pointers or similar electronic devices - fine 5000 (6400 USD)
Wetin happun between Nigeria and DR Congo bifor?
Meanwhile, DR Congo go play intercontinental qualifier for March wey go decide which two teams go enta di World Cup for Canada, Mexico and United States.
But di Super Eagles say dem no go gree; dem file petition to Fifa say some of di players wey di Leopards of DR Congo use for dat game, no qualify to play.
Nigeria tell Fifa say wetin DR Congo do na "fraud" as dem claim say some of di players wey recently switch dia nationality to play for di Leopards no dey eligible to play for dem.
Di federation believe say players like Aaron Wan-Bissaka wey dey play for Westham, Axel Tuanzebe wey dey play for Burnley and Tephy Mavididi wey dey play for Leicester City, no dey eligible sake of DR Congo no dey allow dual citizenship.
"We believe say dem deceive Fifa to clear dem," Nigeria football federation secretary Mohammed Sanusi tok at di time dem file di complaint.
"For Congolese rule, pesin no fit get dual nationality but some of dia players get European and French passport."
"Dis be wetin we dey tok say na breach of Fifa regulation. We dey tok say na fraud."
Di NFF say dem bin present document and oda legal arguments to Fifa for dis mata wey dem dey expect positive ruling.
Meanwhile, Fifa neva tok anytin ontop di petition wey Nigeria submit and di World Cup intercontinental play-off go soon begin.










